Eastman Kodak company dey port from producing photography film to production of medicine. Di 131 years old company bin dey number one position for di manufacturing of film wey dem dey take snap photo for many many years. Di camera company and photography giant fail to cross enta di 21st century era of digital cameras, even though na dem invent di first digital camera for 1975.