United States mark dia 250th birthday wit fireworks and flyovers - but celebrations across di kontri bin dey complicated sake of extreme weather. "Di American dream don come back," US President Donald Trump bin tell one cheering crowd during one delayed rally for Washington National Mall, bifor wetin e describe as di world largest firework display. Di 4 July federal holiday remember di 13 US colonies as dem sign di Declaration of Independence in 1776 to end British rule. Despite di celebrations, pipo don criticise Trump say e make imsef central to di milestone and say e politicise di celebrations....