White House tok say Donald Trump and im close advisers dey discuss different options on how dem fit take over Greenland, as di US president still dey argue say e go help improve America security. Leaders for di island don reject im demands, same as Denmark wey be Nato member and di kontri wey Greenland dey under as semi-autonomous territory.