Actor James Van Der Beek, wey pipo sabi for im role for US teen drama Dawson Creek, don die at di age of 48 after dem diagnose am with bowel cancer. "Our beloved James David Van Der Beek pass peacefully dis morning," im family tok inside statement dem post to im social media accounts. "E meet im final days with courage, faith, and grace."